Sports News

BREAKING: Famous WWE Wrestler Jon Huber( Brodie Lee) die [watch video]

US wrestler Jon Huber, wey fans know as Brodie Lee or Luke Harper, don die aged 41.

Huber wife Amanda tok for post on Instagram say: “Loved ones surround am wen e die after a hard fought battle with non Covid related lung issue.”

Im compete as Luke Harper for WWE, before e leave for 2019 and join All Elite Wrestling (AEW) as Brodie Lee.

AEW say dem dey “heartbroken” at di news of di death of Harper, wey stop to fight for October.

Wrestling legend Hulk Hogan say im dey “totally devastated” over di loss of “a great talent and awesome human being”.

Totally devastated over the loss of Jon”Luke/Brodie”,such a great talent and awesome human being! RIP my brother HH

— Hulk Hogan (@HulkHogan) December 27, 2020

Triple H also call Jon Huber an “amazing talent”, but say im be “better human being, husband and father”.

Amazing talent ….
Better human being, husband and father. https://t.co/wc2080Ziar

— Triple H (@TripleH) December 27, 2020

Amanda Huber, wey dey also perform under di name Synndy Synn, describe her husband as “di greatest father” to their two children.

“I never bin want write out those words. My heart dey broken.

“Di world see him as di amazing @brodielee (aka Luke Harper) but im bin be my best friend, my husband, and di greatest father you would ever meet.

“No words fit express di love I feel or how broken I dey right now.”

View this post on Instagram
A post shared by WWE (@wwe)

Cody Rhodes don dey for ring with Brodie Lee, and e post on Twitter say im dey “honoured and privileged” to be di “last pesin wey Brodie fight”.

Thank You pic.twitter.com/gbBD49IwDH

— Cody (@CodyRhodes) December 27, 2020

Matt Hardy post: “I dey shattered over Brodie passing. Im bin dey full of life with e wife and young children wey im love.

“A devastating reminder of how fragile life be. Rest well, friend.”

This was my Bday, which I share with Doc. Brodie & Miro photobombed us & we all shared a great laugh.

I’m shattered over Brodie’s passing. He was full of life with a wife & young children he loved. A devastating reminder of how fragile life is. Rest well, friend.#RIPBrodieLee pic.twitter.com/3p5BH18YIr

— MATT HARDY (@MATTHARDYBRAND) December 27, 2020

WWE say dem “extend their condolence” to di “family, friends and fans” of di former Intercontinental Champion.

Source: ReportGhana

Related Articles

Back to top button
error: Content is protected !!